Morning my beautiful sis, abeg who don dey this my shoes before, my hubby just came back from from travel o, even as his driver say madam no worry make it go bring oga for airport alone, I say no I join am, na here my story start o ,na so I see hubby with plenty bags one of the bags my name was there, see happiness na I jump up hug hubby with kiss o, come and see how I dey smile, dey do conner eyes of love, for my mind I say all this for me, and was even thinking about who to give out my old clothes so that the new ones go see space, after patiently waiting for hours to open the bags cos hubby dey rest, guess watin dey the bag na books, na so my face change, I now ask why books if he wants me to open books shop, that is how he continue saying, you want to finish your course and doing your project it will not be difficult for me and con see the plenty money when he use to buy the books , with all my expectations say I go dey dress to kill, I still dey vex.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment